Sunday 17 January 2016

Shalom's Creed With Charles XIX: My Conversation With God.

**Phone rings
Me: Hello, Baba God, na me o😃
GOD: Ah, Chale, How you de na?

Me: Baba, I de oh, see me just de fresh, your son on fleek this 2016, I just de levitate...

GOD: Na so Chale, just de meditate, you gas levitate, no be me born you?

Me: Na you na. Baba, thanks oh. How Jesus de na?

GOD: Jesus de fine oh; him de my right hand. Him de hail you. Him de talk about you to me all the time like say na only you de dis world.

Me: Jesus, u too mush abeg! I de hail oh! Who fit make use portorportor make person see? Who fit make water sweet pass red wine? Who fit make leg commot for person wey no get leg before? Who fit talk to 5000 men for 3 days, them no tire. You come use 5 slice of bread  and 2 fish feed them on top. Chop knuckle abeg! I no fit hail you finish, you too mush! I see you! Twale!

GOD: Chale, you de sweet ma belle

Me: Ah Baba, the kind love you show me pass wetin I fit talk oh. See me de dance shoki, kukere, awilo, alanta, all join.

GOD: Chale, you fit dance oh! Who teach you? Hope say no be channel o

Me: Tah! na my padi wey you give me, Holy Spirit. Him de burst ma brain! Kai! Wetin him neva teach me? Even wen I de exam hall, na Him de remind me everything wey I don read. Even if the part wey I no read commot, him de help me freestyle. I just de move stuff, de win souls left, right and centre, I de heal the sick, raise de dead, see me de feel like hero!

GOD: Na so na my boy, you be hero. So wetin you wan do today?

Me: I de go shush na, make I sing and dance for you na, hear wetin you go use pastor tell me...

GOD: that's my boy. I go bless you yafu, yafu today. Check your phone

Me: Ah Baba, na alert oh! Chai! Thank you oh. Make I hurry go shush. I no wan late.

GOD: okay na. No forget say I love you pass anything and no forget tell your friends about me this week. Bye.

Me: Baba, I love you too! Muah! My Padi, Holy Spirit,  go help me tell my friends about you. You de make me kolo. Bye Bye my Lord, God and friend. Talk to you during church service.

*Drops phone.

Note: God is more than a heavenly being. He is a mighty lover of your soul. Find time to communicate to Him frequently being conscious of his love for you.

Your life is great!
Love.
                                                      #Oshamo

No comments:

Post a Comment